Return to Website

Skeezee-reez´s Discussion Forum

Let´s rub our minds together to see how we can be creative symbiotically

Skeezee-reez´s Discussion Forum
Start a New Topic 
Author
Comment
SAYING OF OUR PEOPLE

Goat wen follow dog waka go sabi chop ****

Re: SAYING OF OUR PEOPLE

na from the smell of mess dem go know how **** go smell

Re: SAYING OF OUR PEOPLE

Na small small na in brochus take dey big

Re: SAYING OF OUR PEOPLE

Na small **** dey spoil yansh

Re: SAYING OF OUR PEOPLE

Wetin old man siddon for ground dey see, small pickin wen climb iroko tree no go fit see

Re: SAYING OF OUR PEOPLE

''na only yansh know the reason why e face back''

Re: SAYING OF OUR PEOPLE

Pikin wey say eh mama no go sleep, that pickin too no go sleep.

Re: SAYING OF OUR PEOPLE

small boy when hope for he father house na

Re: SAYING OF OUR PEOPLE

Ogogoro na talk say e no be water o, But if you take water eye look am, e go surprise you

Re: SAYING OF OUR PEOPLE

NA where short man hand reach na im e go hang im pant.

a word is enough for the wise

what shall it profit a man to gain the world and suffer the loss of his soul

Re: SAYING OF OUR PEOPLE

Frog wey cross python front for daylight dey do so at im own risk!
Hyena wey disturb lion as im dey chop runs the risk of becoming part of the meal !
Na who no get work go see goat wey climb tree.
Goat wey kill lion na he no wetin he wan used am do!!

Re: SAYING OF OUR PEOPLE

Its right for a child to laugh as loud as he/she wants but he/she should also remember to have enough Lips to cover the teeth.

''den nor say make small pikin, no laugh d way him like oh, but make him get enough lips to cover the teeth''

Re: SAYING OF OUR PEOPLE

The pikin way put eye for him granpapa slippers, na leg him go take go Heaven.
also the pikin way put eye 4 him papa property,na heaven him go 4 inherit d property.

Re: SAYING OF OUR PEOPLE

fly when no dey Hear word, dey follow dead body enter grave.

Re: SAYING OF OUR PEOPLE

Them no say make Penis nor plan for TOTO Oh, but make him ready finish waiten Him start, by standing all through the journey.

Re: SAYING OF OUR PEOPLE

Take am easy:
Na wen you wan **** finish naim you dey **** for body!

Re: SAYING OF OUR PEOPLE

If a bird learns to fly without perching, an hunter should learning to shoot without aiming

Re: SAYING OF OUR PEOPLE

Na wetin Person get na im e dey take make yanga. Na dis make Pig brokos dey 4 back.

Namanama wey no get tail na God dey drive fly from im body.

if ur person dey 4 top of orange tree, you no go eat back of orange

fly wey no behave well must ready to follow dead body enter grave

Re: SAYING OF OUR PEOPLE

grass way dem cut go surely grow back only if you pull am out from hin root.

Re: SAYING OF OUR PEOPLE

Rat way follow lizard enter water, if lizard body dry? him own body go dry?